--Advertisement--
Advertisement

Na true say Shell dey comot Naija?

As Shell announce say dem dey end dia onshore exploration business for Nigeria, some social media posts tok say di British oil giant dey comot di kontri.

Na so some Nigerians come dey react to Shell announcement for social media with different comments, togeda with di ones wey no dey correct. 

Some of di posts, wey gada thousands of likes and retweets for X, tok say Shell don end dia business wey pass 80 years for di kontri.

“Shell just announce say dem dey comot Nigeria. Wetin dis oyinbo pipu dey see wey we no dey see?” na so one X user, @Naija_Activist, tweet.

Advertisement

Anoda user, @_pheranme, folo make di same post wey claim say Shell don comot and di user ask say: “Wetin dey hapun for Nigeria?”

For X user @ThisIsNot1967_, di claim be say “Shell BP don comot dis Nigeria wey dey sink afta 85 years operations”.

Advertisement

DI TRUTH WEY WE COMOT FROM DI CLAIMS

As dem dey announce di changes for Nigerian business structure, di kompani tok say, afta dem get di necessary approvals, dem go sell Shell Petroleum Development Company of Nigeria Limited (SPDC). 

Di new pipu wey go buy di business na Renaissance — one group of five companies wey get four exploration and production companies inside Nigeria and one international energy group. Di companies na ND Western, Aradel Energy, First Exploration and Production (First E&P), Waltersmith, and Petrolin.

Na SPDC dey operate di NNPC/SPDC/Total Energies/NAOC joint venture, wey get Nigerian National Petroleum Company Limited (55 percent holding), SPDC (30 percent), Total Energies (10 percent), and di Nigerian Agip Oil Company Limited (5 percent).

Inside statement wey dey tok about di reason why dem dey end dia onshore work, Shell explain say becos dem sell one of dia Nigerian subsidiaries no mean say dem don comot, say dem still get “three oda main businesses” for di kontri.

Di energy firm mention di businesses as Shell Nigeria Exploration and Production Company Limited (SNEPCo), Shell Nigeria Gas Limited (SNG), and Daystar Power Group, wey dey provide solar power give commercial and industrial businesses across West Africa.

“In addition, Shell get 25.6% interest for NLNG, wey dey produce and export LNG to global markets. Di interest wey Shell get for NLNG folo dey outside dis transaction,” na so di statement tok.

SHELL STILL DEY DO BUSINESS FOR NAIJA

SNEPCo, di kompani wey first start deep-water oil and gas production from di Bonga field for di Gulf of Guinea, suppose continue dia production and exploration activities.

Also, Daystar, wey Shell bin buy for December 2022, go still dey Nigeria.

Even SNG, wey dey currently operate one growing gas transmission and distribution network of over 138km for Nigeria, go still dey di kontri.

DI REASONS WHY SHELL END DIA ONSHORE BUSINESS

Shell decision to sell di onshore subsidiary no be surprise, as di kompani dey struggle with oil spills becos of theft, destruction, and operational issues, wey don cause expensive repairs and high-profile court cases.

Na di court cases bin make wey di kompani no sell dia onshore assets before now.

During one annual general meeting for 2021, Ben van Beurden, former chief executive officer of Shell, tok say di oil giant bin dey reason with di federal govment to sell dia onshore oil assets, sake of heavy destruction.

In March 2022, one court of appeal for Owerri no gree make Shell sell any of dia assets for Nigeria until dem reach decision ontop di kompani appeal of over $2 billion as penalty from alleged oil spills.

In July 2022, Shell paused di divestment of dia onshore oil assets until di outcome of di case for supreme court.

ODA MULTINATIONALS DEY SELL DIA ONSHORE ASSETS

Some oda international oil companies (IOCs) don folo sell dia assets.

In February 2022, Seplat Energy Plc gree buy all ExxonMobil share for dia shallow water business — Mobil Producing Nigeria Unlimited (MPNU).

However, afta over one year, di deal neva complete sake of some regulatory process wey dey block road.

In April 2022, TotalEnergies announce say dem dey plan sell dia minority stake for one Nigerian oil joint venture, togeda with oda top firms wey dey divest from onshore oilfields for di kontri.

Even Oando, for September 2023, tok say dem bin sign deal to acquire 100 percent of Eni shares for Nigerian Agip Oil Company Limited (NAOC Ltd).

Equinor, di Norwegian oil firm, for November 2023 tok say dem bin gree sell dia Nigerian business, including di kompani stake for di Agbami oil field, to Chappal Energies, one Nigerian-owned firm.

FINAL TOK

Di claim wey tok say oil giant Shell dey leave Nigeria no correct. Di kompani still get ownership for three other subsidiaries.

 

Add a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected from copying.