Advertisement

Na true sey Matawalle bury cars for underground tunnel?

One viral foto for social media claim sey Bello Matawalle, former govnor of Zamfara, bury cars inside ground.

According to wetin dem write for di foto, di cars wey dem claim sey Matawalle — now minister of state for defence — bury na brand new vehicles.

“O! Cry for our people and country!” na so di caption tok.

“Plenti brand new vehicles wey ex-Govnor Matawalle of Zamfara State buy bury secretly for underground tunnels. Why Black pipu dey heartless like dis?”

Advertisement

For di foto, dem bury motor wey resemble sport utility vehicles (SUVs) inside ground, come use sand cover am.

Di foto, wey dem share evriwhere for WhatsApp, come appear for one X page wey belong to VANPDP, some pipu under di Peoples Democratic Party (PDP) wey claim sey dem be support group.

According to di page, dem “Discover di vehicles come seize am from di Ex-Gov of Zamfara state, una current Minister of State for Defence”.

Advertisement

Since dem make di post on December 14, e don gada pass 170k views, 598 likes, 428 retweets, and 374 likes.

“Dem must cari am go court for stealing,” na so one comment from Emmanuel Enoidem, senior advocate of Nigeria (SAN) and former national legal adviser to di PDP, tok.

Di claims still comot for TikTok ontop one page wey di name na awakeningafrica1 wey e gada pass 811k views, 12.2k likes, 739 saves, 469 comments, and 353 shares.

But na true sey di minister bury plenti cars underground?

Advertisement

WETIN WE CHECK

Advertisement

As we cari reverse image search look di foto, TheCable see sey dem post am about three weeks before e begin dey waka for Nigerian social media. 

“See wetin di IEA army discover for Balkh Province,” na so one X post wey dem make on November 23 tok

Advertisement

Balkh na area for northern Afghanistan, kontri for south-central Asia. Di Taliban militant group begin control di kontri again for 2021 and dem declare am di Islamic Emirate of Afghanistan (IEA).

Anoda Reddit post tok sey na “former corrupt Afghan politicians naim bury di vehicles before dem comot Afghanistan”.

Advertisement

Internet search still come show sey reports fromDecember 4 tok sey afta Matawalle lose im reelection bid, im bin allegedly cari ova 50 state vehicles with am.

Dauda Lawal, govnor of Zamfara, folo accuse Matawalle, sey im hold state official vehicles.

Advertisement

Howeva, no beta media reports don confam set dem bury car for Zamfara or anywhere for Nigeria — and e no get any oda one to confam sey dem bury di cars for Afghanistan either.

FINAL TOK

Nobody fit prove di claim wey sey Matawalle bury plenti cars underground as evidence no dey.

Add a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected from copying.