Advertisement
CHECK AM FOR WAZOBIA

Naija fuel na di cheapest for di world as Eniola Badmus tok?

BY Claire Mom

Share

Eniola Badmus, one Nollywood actress, tok sey even as dem comot petrol subsidy, fuel price for Nigeria na still di cheapest for di world. 

Di actress, pesin wey no dey hide to support President Bola Tinubu, make di claim wen Daddy Freeze, media pesin, invite her make she tok for im Instagram live.  

Badmus tok sey many of di pipu wey dey use mouth finish Tinubu govment no sabi di beta wey come as dem remove petrol subsidy. 

“As Naija citizen, I get right for wetin I dey tink. I fit support anybodi wey I wan support,” na so she tok.

Advertisement

“All dis pipu wey go just gada for phone dey type no even sabi wetin subsidy bi. Na wen govment comot am naim dem come sabi wetin dey hapun. Even now laik dis, bi like sey na us still dey buy di cheapest fuel for di whole world. 

“President Tinubu tanda gidigba. Comot di support wey I dey support am, I don see wetin im dey do and I know wetin e go do. I neva see pesin wey kind wey get good heart like di wey our current presido bi. Till e comot from dia, I go dey by im side.”

DI PETROL SUBSIDY WEY DEM COMOT

Advertisement
Advertisement

On May 29, Tinubu, as im dey give im first speech as presido, tok sey petrol subsidy no dey again.  

“Ontop fuel subsidy mata, unfortunately, di moni wey dem kip before I enta office show sey no space dey for fuel subsidy. So fuel subsidy no dey again,” na so im tok.

Im add sey di moni wey dey increase ontop subsidy no make sense again especially as resources dey finish for kontri. 

“We salute wetin di forma govment do as dem comot petrol subsidy wey bin dey favour di rich pass di poor,” na so im tok.

Advertisement

“Instead, we go shift di moni do beta investment for public infrastructure, education, health care and jobs wey go improve di lives of millions of pipu.”

Afta Tinubu make im speech, e no tey wey petrol price jump from N190 per litre pass N500 per litre.

On July 18, oil marketers again increase di price of petrol for stations go N617 per litre for Abuja and N568 per litre for Lagos. 

But na true sey fuel for Nigeria na di cheapest for di world? TheCable check di price of petrol for different kontris for di world and na wetin we find bi dis. 

Advertisement

AS WE CHECK DI PRICE OF PETROL FOR DI WORLD

According to Globalpetrolprices, world market leader wey dey track di prices of motor fuel, electricity, and natural gas for over 150 countries, di oil wey dem dey sell for Venezuela na di cheapest for di world. Di current price na N3.1274 per litre.

TheCable still check more informate see sey aside from Venezuela, e still get 20 other kontris wey dem dey sell petrol for less dan N617.

Di kontris na; Iran, Libya, Algeria, Kuwait, Angola, Egypt, Turkmenistan, Malaysia,Kazakhstan, Bahrain, Bolivia, Iraq, Qatar, Azerbaijan, Russia, Oman, Saudi Arabia,Ecuador, Kyrgyzstan, and Afghanistan.

S/N Country Price in $ as of July 24 CBN Exchange rate on July 24 price in Naira
1. Venezuela 0.004 781.85 3.1274
2. Iran 0.029 781.85 22.67365
3. Libya 0.031  781.85 24.23735
4. Algeria* 0.34 781.85 265.829
5. Kuwait* 0.342 781.85 267.3927
6. Angola 0.364  781.85 284.5934
7. Egypt* 0.372 781.85 290.8482
8. Turkmenistan 0.429 781.85 335.41365
9. Malaysia* 0.448 781.85 350.2688
10. Kazakhstan 0.488  781.85 381.5428
11. Bahrain 0.531  781.85 415.16235
12. Bolivia* 0.542  781.85 423.7627
13. Iraq 0.573  781.85 448.00005
14. Qatar* 0.577  781.85 451.12745
15. Azerbaijan 0.588  781.85 459.7278
16. Russia* 0.589 781.85 460.50965
17. Oman* 0.621 781.85 485.52885
18. Saudi Arabia* 0.621 781.85 485.52885
19. Ecuador* 0.634 781.85 495.6929
20. Kyrgyzstan* 0.741 781.85 579.35085
21. Afghanistan 0.743 781.85 580.91455
22. Nigeria 0.778 781.85 608.2793
23. UAE* 0.787 781.85 615.31595
24. Tunisia 0.832 781.85 650.4992
25. Bhutan 0.845 781.85 660.66325
26. Lebanon* 0.863 781.85 674.73655
27. Indonesia* 0.864 781.85 675.5184
28. Colombia* 0.867 781.85 677.86395
29. Pakistan* 0.878 781.85 686.4643
30. Argentina* 0.924 781.85 722.4294
31. Belarus* 0.935 781.85 731.02975

Make you sabi sey 19 out of di 23 kontris dey sell petrol for less dan N568 per litre, wey bi di cheapest price for Naija today.

FINAK TOK

Di claim by di popular actress sey Naija petrol na di cheapest for di world no correct. As e bi, 19 kontris for di world dey sell petrol less dan di N568 wey dem dey sell am for Lagos.

For dis tori, di exchange rate wey we use na $1 = 781.85 according to di Central Bank of Nigeria (CBN) as of July 24, 2023, di tym wen di actress make di claim.

This website uses cookies.