Advertisement
CHECK AM FOR WAZOBIA

No, Woodberry neva comot prison

BY Claire Mom

Share

One social media post claim sey dem don release Olalekan Ponle, aka Woodberry, from prison.

Di post don gada pass 14,000 views, 213 likes and 83 repost on X.

Advertisement

WHO BE WOODBERRY?

Woodberry na Naija internet celebrity and friend of Ramon Abbas, aka Hushpuppi, anoda Nigerian wey enta prison sake of internet fraud in November 2022.

On June 10, 2020, dem arrest both of dem for Dubai, United Arab Emirates, ontop extensive international online fraud.

Advertisement

Dem bin come carry dem go di United States for separate trials.

Woodberry, wey bin dey accused of defrauding one US company of $188,000, bin plead not guilty to di charges for over two years.

However, im come change mouth plead guilty to one-count-charge of wire fraud for change of plea hearing in April 2023, at di US District Court for Northern Illinois.

Robert Gettleman, di presiding judge, accept im change of plea for ruling on April 6, convicted am on 8-count charge.

Advertisement

On July 11 2023, dem sentenced Woodberry to 8 years imprisonment, come order am make im pay back about $8 million in restitution to seven of im victims.

WETIN WE CHECK

To confam di claim and check where Woodberry dey, TheCable look di inmate register of The Federal Bureau of Prisons.

The register dey show di name, register number, age, release date and present location of di inmate.

Advertisement

The search show sey Woodberry currently dey di Fort Dix Federal Correctional Institution and im release date na October 2027, two years before Huspuppi go comot.

 

Advertisement

FINAL TOK

Advertisement

Di claim wey tok sey dem don release Woodberry no correct.

Based on informate from di US Federal Bureau of Prisons, di internet celebrity still dey custody dey serve im 8-year jail term.

This website uses cookies.