Advertisement

Video wey show as helicopter fall no be from Israel-Hamas war

One viral video for social media show as dem shoot down helicopters for sky wit rockets.

Claims wey folo di video tok sey na Israeli helicopters bin fall down and sey na Hamas, di Palestinian militant group, naim down am for di war wey dem dey fight.

“See as dem down Israeli helicopters,” na so @Sentletse, confam X user tweet give im 273k followers on October 8.

For di video, two helicopters, one ontop di oda, bin dey fly for one place wey resemble village till rocket come down dem, na so di helicopters catch fire. 

Advertisement

As of di time wen dis tori comot, di post gada 10.6m views, over 8k likes, 3k comments, 1k comments and bookmarks.

Advertisement

On October 7, Arun Gangwar, one journalist wey tok sey e don work wit some Indian news companies including India Daily Live, folo post di video, come support Israel wit im hashtags.

#HamasTerrorists Hamas shoot two Israel helicopters,” na so Gangwar tweet.

As of dis time, di post don gada more dan 214k views, 489 likes, 150 comments, 95 retweets, and 25 bookmarks.

“Hamas fighter shoot two more Israel helicopters for Gaza Palestine,” na so anoda X post from @its_ishaq_khan tok.

Advertisement

Di post gada 27k views, 20 comments, 22 likes, and 14 retweets.

WETIN HAPUN BEFORE

Advertisement

On October 7, di Hamas militant group enta Israel from Gaza through di air, land and sea, to open anoda chapter for di complicated war wey Israel and Palestine don dey fight since di world begin. 

After di attack, about 1,400 people, mostly innocent pipu, die. Dem come kidnap nearly 200 pipu.

Advertisement

Gaza, wey dey controlled by di militant group, na small land wey dey squeezed in between Israel and the Mediterranean Sea, but e get short southern border wit Egypt.

Hamas call di attack “Operation Al-Aqsa Storm”, come claim sey dem plan am for two years.

Advertisement

According to Hamas ogas, dem don fire pass 5,000 rockets enta Israel as revenge for di “rubbish” wey dem do di Al-Aqsa Mosque for Jerusalem and di hundreds of Palestinians wey dem don kpai.

As reply, Israel, through di mouth of Benjamin Netanyahu, prime minister, swear sey dem go destroy di Hamas militant group. Israel come warn di pipu wey dey live for Gaza sey make dem run comot becos di Israeli Defence Forces (IDF) go use force run di city.

But di videos wey dey waka evriwhere for social media get anything to do wit di Israel and Hamas kasala? 

VERIFICATION

One keyword search for X show sey di videos begin dey go viral from October 7, di day wey Hamas do di surprise attack, and dem don dey waka for internet since den. Dem share di latest one on October 10.

Reverse image search come show sey one earlier version of di video bin dey internet on October 3 for YouTube ontop Kazinka Warrior, one video game community page.

“No bi real life situation be dis na just computer acting” na so dem describe di video.

As we cari eye look di page, we see sey oda game videos specifically from Arma 3, one military computer game wey dem act as future war for 2035.

In 2022, Bohemia Interactive, di pipu wey develop Arma 3, bin release statement sey pipu dey falsely connect some viral videos from dia game wit di war for Ukraine.

If pesin wan differentiate game video from real life fight, Bohemia Interactive sey make dem check for signs like low-quality video, particles wey no dey natural like clouds wey no too pure, shaky camera, and human beings wey no resemble real life pesin especially wit dia walking step. 

FINAL TOK

Di viral video wey show as two helicopters fall from sky sake of sey dem shoot am with rocket no dey connected wit d ongoing Israel-Hamas war. Di video na from Arma 3, a military computer game.

Add a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected from copying.